You Wan Kidnap Me Wey No Get Money
0:38
Nigeria
“Okay na, you kidnap person, you say, make you kidnap people wey get money, make them go find them? No. Una no go kidnap those ones, why you go come kidnap me wey no get money? You come dey say, tell the president. Eh? You no know where the president dey by yourself. Na me you wan come kidnap. President wey be say I no relate to by blood. I no be pikin, I no be relative, e nor really too care about me like that. Because let's be realistic, e no really send you like that. You come say tell the president. Wetin make you feel say person wey you no relate to by by blood, no be your father, and no be your mother, no be your anybody. You go hold innocent Nigerian. Eh? You come dey call the president, you feel say that one go shake am?”